

I was chatting with a friend yesterday,and in the course of our chat the question came up. Abeg ejoor, make una help me answer am cos the question vex me. How can she compare tailors to PHCN?Una know say i be Tailor(I no go lie, no bi say we dey disappoint but sometimes work dey overwhelm us na why e dey bi like dat..coughing..)so una go think am well before una answer,and no forget say both dey important in the life of every Nigerian.God is watching o...
6 comments:
Na PHCN, atleast tailor own be say yu still fit call police for dem but PHCN be say yu dee helpless cos even d president sef no know wetin to do.
Lol, tailors can be annoying sha, and dey can disappoint wella, but phcn no get rival. Na dem worse pass o.
Phcn is the worst set of people that can frustrate you and there is nothing you can do them.
Both are the same....disappointment all the way
Ah! Na tailor worse pass o, wit NEPA yu are sure of disaptmnt and so backup generator dey on standby... With tailors, just wen yu tink yes, yu finally hav a trustworty tailor, your dresses wuld either neva be sewn on time, or be badly sewn...
I think tailors disappoint most, phcn get alternative but as 4 tailor u fit put all ur hopes in him/her and at d end of d day u become stranded! Chi no be u oh, my tailors in d past don show me pepper.
Post a Comment